I've seen a lot of shit for the music
If i yarn you e go scatter your skero
We for don kpoof but we striving on a low
And we thank God for his Grace that overflows
Remember back then in Uniben
Met a lot of niggas, made a lot of friends
Candas and Chibuike, IK, Afropriest and Ziko
I remember all the trips we been catch o
From tracking babes for hall 2, to night class, so many things we been through
Your eyeglass, your smile wey dey confuse
We dey jack book we dey set formation
We no like school but we love education
Photographer wey sabi shoot shot
Original guy when sabi lock up
Chibuike call me on my phone
Tell me say Candas dey loss
Oh no!
The news weak me i catch e cold
Na January we talk for phone
I thought it was a joke and i swear i couldn't cope when i saw pictures of Candas declared missing
Now its 7 months
God what is happening
Na which kind life be this, what's really going on
School dey one side
House dey one side
My Babe dey one side
Everything jam pack for our head
And we dey try, we dey hustle for the bread